Politics

Turkey vs Portugal Euro 2024 live updates – BBC News Pidgin


Wia dis foto come from, Getty Images

All eyes go dey on di 2016 Euro champions, Portugal as dem face Turkiye for dia second group match on Saturday.

Portugal forward Diogo Jota say im side dey “expect a completely different game” wen dem face Turkey for Group F.

For dia first group match, na stoppage-time goal from substitute Francisco Conceicao na im Portugal need to beat di Czech Republic 2-1 on Tuesday night for Leipzig.

Dem bin cancel Jota goal sake of offside afta e enta as substitute.

“Turkey get beta players pass Czech Republic and dem go want play different kind of match,” Jota tok.

“If we fit impose our game like we do against di Czechs, e fit go even better because Turkey no dey used to defending in a low block.

“If e happen, we fit try to come away with di three points and qualification.”

Three points for Portugal go secure dia progression to di knockout rounds.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Diogo Jota play im first match for Portugal for 2019

Turkey ‘dream’ of knockouts

Meanwhile, Turkey boss Vincenzo Montella say di “dream” na to beat Portugal and qualify for di last 16.

Di 3-1 victory wey dem get against Georgia na di first time Turkey win dia opening group game for di European Championships.

Turkey balance on top of Group F wit three points, Montella team go qualify for di knockout stage if dem beat Portugal on Saturday.

“Dis na di first time we don win our first match and we don pass di group stage for di last three Euros; we no even pick up one point last time,” Montella tok.

“Our first target na to win our opening match. Now wey we win am, di dream na to win di next one and reach di knockout stage.”

Match stats

Portugal dey enta dis match wit impressive record against Turkey – dem don win seven out of nine matches, and Turkey win two.

Hakan Calhanoglu bin complete 88 of im 95 passes for Turkey 3-1 win over Georgia – di highest number wey any Turkish player don get for di history of European Championship.

Cristiano Ronaldo no score any goal for im three appearances against Turkey.

Di last time di two sides meet na for March 2022, and Portugal win 3-1.

Turkey neva beat Portugal since 2012 and dia previous victory happun for 1955 – both wit di score line of 3-1.

Dis na di fourth meeting between Turkey and Portugal for di Euros. Portugal win all dia last three encounters for di tournament, and dem no concede any goal: 1-0 for 1996 (group stage), 2-0 for 2000 (quarter-finals) and 2-0 for 2008 (group stage).

Di match go start by 5:00 O.clock and BBC pidgin go bring una live text updates.



Source link